LYRIC FOR SALE

Buy this lyric today!

Get Up and Get It


Artist: ennydoc
Artist's Description
Lyrics in distinctive Nigerian patois that easily fits into fast danceable beats

Genre(s): Hip-hop/Rap, Freestyle Rap
Mood(s): Determined, Optimistic
Style(s): Motivational
Language(s): African Languages,English,Indigenous Languages

Get Up and Get It

By ennydoc
Stanza 1:
I bin dey there jus dey cry
Jus dey beg God make im give me money
Na so so flows bin dey flow
I bin no no say na money
Until the thing choke my throat
And water full my eyes
Na so I begin to sell my flows
And now na so so to flex

Chorus:
I dey flex like king wey I be
Unto the small thing wey I sabi
Nah Baba God bin show me the way
If you play this music you go fit find the way
No dey yarn say your brokeness don tey
For everything to shelle na just one day
If you still dey alive, pepper must rest
Just dey do the hustle and give your best
And you ma sef go blow after the test

Stanza 2:
See, poverty na bad thing
But to no know bad pass
How I come know, I no sabi
Wetin I sabi be say na God
Wey turn my tori, show me the way
Of how I go make am with wetin I know
I come clear my bashi, I no come dey owe
Come dey chop for table with big big people
See as we dey chop dey remain turkey leg
Everywhere we go na VIP section

Stanza 3:
Chai, poverty na disease
Wey dey chop person sense without resist
If you think say you sabi, I know say you sabi
If you think say you no sabi, guy, you no sabi
You must to get up with wetin you have
Cos however im be, you get talent
No go do like that guy wey hide im talent

Bridge:
If money don oppress you, this one na for you
To know say your time must surely come
To call people to come chop hot rice and stew
As you dey shout yupi ya yupi yo
Yupi yah yah yah

Contact

Do you want to Work with ennydoc?