[Chorus]
For my life when I want to be what I wanna be
When I see the golden fleece, for the goal, make I no jam Bisaka o
I dey pray cos only God fit grant me this janaah o
I'm almost there, make I no jam Bisaka o
Free me from wahala o
Make we chop Ofe N’ṣala o
[Verse]
No be everybody come from gutter, no be all get silver spoon for mouth
All dey Hustle for morning till night, no time to play
The goal na to dodge sapa, dodge police, dodge bad energy
In da race, till when dem go call you "oga", yesterday na "abeg"
Golden fleece dey always shine for front, e be like say he close
But if bad luck show face, abeg make he no bend us, make we no touch our toes
As we dey run our race,
Jah bless the hustle, make we no jam Bisaka....
[Chorus]
For my life when I want to be what I wanna be
When I see the golden fleece, for the goal, make I no jam Bisaka o
I dey pray cos only God fit grant me this janaah o
I'm almost there, make I no jam Bisaka o
Free me from wahala o
Make we chop Ofe N’ṣala o
[Verse]
Mamas Dem dey pray every night with holy water
Dem dey guide, make village people no spoil your matter"
We wanna ball, make shayo full table, babes come around
From nothing to something, Baba God go turn am around
Golden fleece for hand, he go dey sweet like honey
If we no jam Bisaka o, we go feast on Ofe Nsala oo
[Chorus]
For my life when I want to be what I wanna be
When I see the golden fleece, for the goal, make I no jam Bisaka o
I dey pray cos only God fit grant me this janaah o
I'm almost there, make I no jam Bisaka o
Free me from wahala o
Make we chop Ofe N’ṣala o
[Hook]
If you never hammar the rabbah
Dem go dey tell you wetin to do
Too much talk, too much on wetin you suppose to do huhuu
Bannies no go look your face
Pocket no fit book your taste
As you dey Hustle everyday
Baba.... You no go jam Bisaka o
[Chorus– Outro, repeat loud]
For my life when I want to be what I wanna be
When I see the golden fleece, for the goal, make I no jam Bisaka o
I dey pray cos only God fit grant me this janaah o
I'm almost there, make I no jam Bisaka o
Free me from wahala o
Make we chop Ofe N’ṣala o (Ehhh! Ofe Nsala o!)